\
  The most prestigious law school admissions discussion board in the world.
BackRefresh Options Favorite

I lose my job becos dem give ChatGPT credit for my brain work

Theresa (no be her real name) just quit her office work to f...
https://imgur.com/a/o2g8xYK
  12/23/24


Poast new message in this thread



Reply Favorite

Date: December 23rd, 2024 7:51 PM
Author: https://imgur.com/a/o2g8xYK


Theresa (no be her real name) just quit her office work to focus on her remote writing role for di later part of 2023.

She be part of di millions of Nigerian youths wey take to dollar remote work to fight against di losing value of di naira against di dollar. Either you go run dat parole or you go japa.

Her new role, following her work as copywriter bin dey for content writing. And di company bin stamp dia foot down say make dia writers no dey use Chat GPT for dia.

Theresa tok say, "I bin get dis job last year, wit company wey be from Scotland as content writer. Dem tell me say AI dey frowned upon."

She find out say any time she write submit, dem go accuse am say she use AI take write whateva she submit give dem, di company flag am say na ChatGPT she carry write am.

"As time dey go on, I go write articles from my brain for different topics and my direct oga go tell me say dem don flag am for AI. I go rewrite di articles up to four times even though I sabi say wetin I bin write no be from AI but dem go still flag am. Di mata frustrate me die as I dey work for dem cos e be like say I lose my credibility. And las-las, e end say dem sack me."

Dis mata bad sotey, she by herself, anytime she dey do dia work, she get like four AI checkers wey she dey take cross-check her work so dat e no go be like say she use AI. But dem go still flag am for dia end becos, according to dem, di AI checker wey dem bin dey used dey paid for so e dey more accurate.

Plenti pipo weda codedly or in open dey use AI either as research tool or to helep dem write for either academic purpose or for dia work.

In fact, Akinwande wey also dey do remote work say ChatGPT dey help am wella for di kain automated and fast paced work e dey dey do, E say, "wit my work, we dey use AI bicos of di kain work we dey do and di speed wey we suppose deliver to our oga at di top. We dey use am as template or fil up idea, as e relate to di kain project we dey work on."

Im sef notice pattern on top how Chat GPT dey take repeat some kain words from certain prompts around im work wit social media, so according to am, na to edit di work to sound more human and less "robotic".

For social media, pipo don dey tok more and more about di words wey dem dey take determine say pesin use AI or Chat GPT write wetin e send give dem.

Di experience sour Theresa for her next work opportunity wey she say she no dey use AI but dia policy allow for di use, so na so she lose dat work opportunity.

"Di mata bin make I start to dey fear sotey wen I bin dey interview to do copy writer work for company for America, dem ask me weda I dey use AI to write and of course, I tell dem say I no dey use am only for dem to tell me say dem dey use ChatGPT take write, and na why I lose dat opportunity."

Since pesin bin write im view on top how e dey take find out weda pesin wey mail am dey use ChatGPT or not take form di email, plenti tok-tok don start online on top weda pipo wey dey speak English as dia second language dey punished for dia understanding of di language.

Theresa say, "so, as I dey see di trends for Twitter (wey now be X) of some words wey pipo say dey ova used by ChatGPT, wey be words wey Nigerians dey use normally, e just make me gbab say, oh na wetin cause di wahala wit di company wey I bin dey work for."

Pipo don also share dia tori online on top how dem don dey flagged for di big grammar wey dem dey use officially wey dey flagged as ChatGPT for dia professional life.

Theresa comot wit wetin she believe say be di cause of her own dragging for dis ChatGPT mata.

She say, "I bin grow up dey read books from pipo like Chinua Achebe, Cyprian Ekwensi, Chimamanda Ngozi Adichie, Buchi Emecheta, Flora Nwapa and I build strong vocabulary sotey my friends go tell me say I be walking dictionary.

"I dey also tok like I take dey write, I dey use wetin some pipo fit call big grammar and looking back, e be like say, AI bin dey flag am say na di kain big words wey only AI tools fit use or di company ogas go fit reason say wia dis girl dey from come, her side of di world, she fit no get dis sense to use dis kain words, so definitely she dey use AI. "

According to one study wey Cornell University bin do for 2023, dis GPT detectors dey biased against pipo wey no be native English speakers and dey give false positives up to 70% of di time.

Pesin dey type wit ChatGPT

Wia dis foto come from, Getty Images

ChatGPT na Artificial Intelligence Technology chatbot wey OpenAI company found and launch for November 2022.

OpenAI na artificial intelligence research firm wey im founders include Elon Musk.

Artificial Intelligence (AI) Technology chatbots dey designed to answer questions and find information. ChatGPT na di best-known example.

E fit write essays, scripts, poems, and solve computer coding as human-like way. E fit also do conversations and admit mistakes.

Di GPT stand for Generative Pre-Trained Transformer. Dis mean say e dey learn wetin to tok by capturing information from di internet.

E go come use all of dis information wey e gada from di internet to "generate" responses to questions or commands wey pesin ask.

Di amount of text for di internet and inside digitised books plenti sotey ova plenti months ChatGPT bin dey learn how dem go take combine words for meaningful way by imself, with humans wey dey help am adjust di ansas e dey give.

Imagine say you get plenti books for foreign language, and maybe some get images.

Las-las you fit find out say na di same word dey appear for page wia drawing or picture of tree dey, and anoda word for picture of house.

And you go see say word dey near dose words wey fit mean "a" or maybe "di" and so on.

ChatGPT do dis kain close analysis of di relationship wey dey between words to take build huge statistical model wey fit use predictions and create new sentences.

E dey use plenti computing power wey allow di AI to memorise plenti words, alone, in groups, in sentences, across pages, - and den dem go read and compare how dem dey use dem ova and ova again in less than a second.



(http://www.autoadmit.com/thread.php?thread_id=5653528&forum_id=2\u0026mark_id=5310864",#48480138)